Home Features Style & Beauty Entertainment & Arts NA Life Body & Soul Editor's Page News/Events

 

Amebo's corner

Wealth & Career

Discussions

Submit an Article


Una Say Una Want R-E-S-P-E-C-T

Which one we dey sef? Even me Amebo, I don tire for una!

Una woman we dey shout every time say una wan RESPECT! Any man wey come near dey side, before de man even open mouth, dey woman go shout, “Make you respect me O!” If you tell am make e help you bring water, e go say wetin? You tink say I be slave? Ehn Ehn, make you give me my respect O! Na so so English e go begin to de speak. Who no wan respect, me I want am, even dog wey dey chase rat for market, dey warn de rat say “ Ol boy, make you give me my respect O! Ok as we all want am, wetin happen say we no dey receive am? Because respect na de kind ting person go earn! Una hear me so?

Ok check am, e get dis girl wey wan take abuse kill de taxi driver way splash water for am. Say taxi driver no dey fear! Say taxi driver no dey respect person for road. Truth be say, no be taxi driver fault, e no fit see road again because dey girl sef wear one short miniskirt wey dey grip in yansh and remain small im breast go jump comot im blouse, so Oga taxidriver come dey confused. When e bin wan turn left, na so the girl yansh begin dey shake yere yere, e come turn right by mistake, E sef dey shout, O girl wetin be your problem, why you dey wear dis kind cloth eh! You for naked yourself, at least, if people see you naked, den go give you the kind respect den dey give to mad people.

 

< Discuss this Article Email this Article to a Friend >

Archives

   Spoil Man

   Too Much Perfection

   All We Are Saying