Home Features Style & Beauty Entertainment & Arts NA Life Body & Soul Editor's Page News/Events

 

 

 

Discussions

Submit an Article


All we are saying...

I just want to understand why my people dey too front. Na so one girl wey dey carry so so fendi and Gucci dey parambulate come disgrace herself O!

Anytime you see am for road, e go just fresh. Every cloth we dey im bodi, na designer. One day, I come ask am, wetin im dey do...wetin be im profession. E begin tell me long tori. My sisters, if person no fit tell you de ting wey im dey do for one sentence, de person no get betta job. I come dey look dis girl dey wonder say na 419?

Anyway, one day, we come go dis girl house, becos of meeting. Na im snow come fall so te, we no fit comot again. Na so we come carry ourselves begin do slumber party for dis girl's house. We dey laugh, de jollof, when next thing Nepa come take light. I come shout Haba Nepa! But we dey america, abi Nepa hand don reach dis place? The girl begin tell us tori. Na im one girl come tell me, im see disconnect letter for the girl bathroom. So dem cut the girl light. As we dey suffer dat one, one girl begin talk say, it is freezing. Again the girl begin talk tori. Dem don cut im heat as e no pay gas bill. My eye come red. I begin shout.” You dis yeye girl, na only to wear designer, na im you sabi, you no sabi to pay bill?

My sisters, na so we come freeze dat night. Infact as I dey tell una dis ting, na only yesterday, wey my yansh begin shake like before, the cold make am hard like rock. My boyfriend come dey vex well, well.

Nowadays, anytime, I see dat girl, I go begin sing, all we are saying, please pay your bills!

 

< Discuss this Article Email this Article to a Friend >

 

Archives

 < Back to Archives