Home Features Style & Beauty Entertainment & Arts NA Life Body & Soul Editor's Page News/Events

 

 

 

Discussions

Submit an Article


Una too dey spoil man

 

E be like say, I always dey shout about something. Make una listen. Dem get some women, wey too dey spoil man.

Make I tell una my story. I come meet one bobo, we begin date, I tink say our love dey flow well, well. Small time reach, bobo say in dey go Naija, make im see in papa. I say no problem. Me I not fit go, because I don't tell my job people say everybody

in my family don die and my vacation time no remain. Anyway, na so dis man begin prepare go.

E come tell me say, make I understand in dey go holiday, and e fit get small fling for side, sebi I go understand. As he come talk dat one, I come understand say dis bobo no sabi me well, well at all. Wetin be fling? Na person name? Una no say I dey craze, but I come chill, make de idiot continue to dey talk. E come tell me say, infact im former girlfriend before me, she sef dey give am condoms, because she know say she be the main person. Meanwhile make I tell una, dis yeye girl dey for picture as in dey chase me, so make I ask una, who be fool. Abi I look like mugu, Imagine the nonsense. Fling ko, fling ni. My sisters I wan slap de man, kick am comot from my life, but I no know dey craze wey carry me, As e begin go Naija, na so I begin go Naija, I tell my job people say, infact my whole familial line don pafuka, and I must to investigate de matter. I talk juju one time, my oga come give me 2 weeks vacation paid. My bobo, na yesterday e comot go Lagos, me sef na tonight I dey go my own.

If una here say katakata dey for lagos, make una know say na Amebo don catch dat yeye man!


 

 

 


 

< Discuss this Article Email this Article to a Friend >

 

Archives

 < Back to Archives